JANGOLOVA

I love you no be for mouth o,
E enter reach down.

Like d bottom pot of jollof,
E sweet me no be small

I love you no be for mouth o,
Area people sef know.

My family members dem sabi,
Say dis ya love, dey totori my head.

Leave a comment

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.